Wednesday, 22 May 2013

It's the kinda house 99.999% of the world will never see ... let alone OWN -- but celebrity icon, Ellen DeGeneres and her wife Portia de Rossi just purchased this $26.5 million mansion in Santa Barbara. 


Yeah! you heard me right.. 26.5 frigging million Dollars.. CHAI!! (Burst ma head)

Omo i gats let you... i mean tell you the rest of the story in Pidgin English.. So, anticipated apologizes to viewers who cant read or dont understand Pidgin English..

*CLEARS THROAT*

Them say the deal been go down through out last week oo, even words no fit pose chest to how chilling this mansion be oo.. From findings, em get 10,522 square feet (No be Psquare oo)... e come dey located for Montecito, wey get the most confam confam mansion for Cali...  Chill oo, i never finish.. them say the mansion get 6 bedrooms and 6 bathrooms.. Lmao dat na confam cruise oo.. and finally em compound come be 13 ACRES of Land. (Chia! Ego dinma oo - Money is good oo, u know how many Okechukwu & Sons Limited i fit build dere *sigh*)
 

Ehnn henn, before i forget..  em also get 9 fireplaces... even the swimming poolu's get ocean view. (in igbo accent)
I never burst una head finish oo.. the one wey craze pass be say, na the latest house Ellen just add to her list.. E mean say Aunty get mansion like water...



Well, my heart don dey beat too fast.. Sha make una sheck the 
pishures of the mansion down down Below..

 
 
 
 
 
 
 
 
 
 
 
 

0 comments:

Post a Comment